expr:content='data:blog.isMobile ? "width=device-width,initial-scale=1.0,minimum-scale=1.0,maximum-scale=1.0" : "width=1100"' name='viewport'/> Lydia Gilbert's blog: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home (episode 2)

Thursday 22 October 2015

How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home (episode 2)

As as single guy at 22 years old wey no get any
previous serious relationship or engagements with any
lady before, na every platform wey i fit use get a girl na
hin i day explore.,Twitter,Facebook,badoo,Nairaland and
boku dating sites.
I bin get everything wey man suppose get. Finacially
stable ( small sha) ,Tall, deliciously handsome and
breathtaking with 6 packs ,light in complexion as i con
add pink lips join with a perfect gap tooth..i get Davido
dimple,kiss Daniel lips,iyanya's body.wizkid Skin ,Lynnx
height and Korede bello eyes.
But every of my attempt to get a girl in a Serious
relationship no dey comot well.Some of
dem go end up
putting me for friendzone. Different kind of zones.Some
recharge card zone, some come and help us check the
Generator" Zone, some na "what time is the lecture "
Zone,and many more zone wey dem bin they put
me.Infact i bin don turn zonal officer for dem girls hand.
I be day think say this dis thing na Spiritual and don
dey plan just date any girl wey i see next,whether na
olosho or not, i no care.. At 22,I never get girl wey go
day call me "honey pie" , sweetie" yoghurt and all dese
names wey fit give person diabetes.Even if my boo get
a boo,right now..I no send..

No comments: