expr:content='data:blog.isMobile ? "width=device-width,initial-scale=1.0,minimum-scale=1.0,maximum-scale=1.0" : "width=1100"' name='viewport'/> Lydia Gilbert's blog: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home (episode 4)

Thursday 22 October 2015

How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home (episode 4)

Na so i dey go
church,weddings.saloons,cinemas,shoprite dey look for
babe oo.He worst reach sotey i be jam one dwarf,we
been date one week as i yarn say i wan do the thing,
way me bin day think say she no get option
than to
gree. Na hin she reply " do u think am in your level ??
Oh i see d mistake i made .." Na dat day dwarf destroy
and break up with me.
I bin no day see success for Social networking dating
before so i no too day put focus for matter Like that
especially after my painful experience for some
naija babes hand Like introvert,
farano,FlawlessT,Rokiatu,Ishilove and many others wey
no go even bother reply my pm.The insult of my life wey
i receive from misssclassy and halfrica kukuma
discourage me from getting anyone from warri,
after all missnora bin day use another person pics dey
deceive guys since.
If i been day tell you my experience for woman hand,in
order just to lose this my virginity,we go use like 10
episode's talk am.But bros.,na Ibadan we day go, make
we no day divert direction go Owerri .
So you can imagine my excitement when i been jam
this new babe for 2go.

No comments: